970x250
750x300
World news

Profile of popular Nigerian Prophet TB Joshua

Di news of di death of Temitope Balogun Joshua wey also dey known as T.B Joshua don send shock wave all over Nigeria.

Di church, Synagogue Church of All Nations (SCOAN) wey T.B Joshua found, confam di sad news on Sunday morning and write say;

“Prophet TB Joshua leave a legacy of service and sacrifice to God Kingdom wey go continue to live on for generations yet unborn.”

Biography of T.B Joshua of Prophet T.B Joshua

Prophet T. B. Joshua na Nigerian pastor, televangelist and philanthropist. E be di leader and founder of The Synagogue, Church of All Nations (SCOAN) wey also dey show live for Emmanuel TV television station from Lagos, Southern Nigeria.

Dem born Temitope Balogun Joshua for June 12, 1963 for Ondo state, Nigeria. According to di website of Synagogue, Church of All Nations, Joshua remain for im mama womb for 15 months before dem born am.

Joshua attend St. Stephen’s Anglican Primary School (Ikare-Akoko, Nigeria, 1971-1977), but e no fit complete one year of secondary school education. E drop out from secondary school e first year and work for one poultry farm.

For school, dem know am as ‘small pastor’ because of im love for di Bible and ability to predict things wey wan happun for im community, SCOAN website tok.

READ ALSO  Who is former US Ambassador to Ukraine Marie Yovanovitch?

E be also di leader of ‘Scripture Union’ during di time wey e dey school.

T. Joshua later found di Synagogue, Church of All Nations for 1987 with just few members wey later grow to plenti members to even outside Nigeria.

‘God has taken his servant Prophet TB Joshua home – The SCOAN

Prophet T.B Joshua dey popular across Africa and Latin America.

For 2009, T.B Joshua start one football club ‘My People FC’ as part of im efforts to help di youth. Two members of di team, Sani Emmanuel and Ogenyi Onazi play for Nigeria Golden Eaglets for di 2009 FIFA U-17 World Cup.

Already, three players don get sponsored abroad to play professonial football for Sweden.

For 2011, Forbes write say Temitope Joshua na di third-richest pastor for Nigeria with estimated net worth: $10 million – $15 million.

Some Controversies wey bin go on about T.B Joshua

Some pipo bin dey criticise T. B. Joshua, sake of di large amount of alleged miracles wey take place for im meetings.

Di Pentecostal Fellowship of Nigeria (PFN), di umbrella association of Nigerian Pentecostal Churches, no gree for di Synagogue Church to be part of dem, dey denounce T. B. Joshua as impostor.

Chris Okotie, Pastor and popular televangelist ifor Nigeria, accuses Joshua of “shamanist practices”.

Christian critics often dey refer to T. B. Joshua unorthodox methods say e no dey confirm for di Bible.

Source: bbc.com

Show More
Back to top button
x
Design by FLY MULTIMEDIA GHANA

Adblock Detected

Please consider supporting us by disabling your ad blocker